Wia dis foto come from, FECAFOOT/FACEBOOK
Published
Read am in 5 mins
For di whole Cameroon, one name don become di toast of di kontri afta her heroics for di ongoing Wafcon tournament for Morocco.
In fact, for some fans, Cameroon gatz build statue for her; afta she use her hands power di Indomitable Lionesses to di Wafcon final.
Goalkeeper Michaely Bihina arguably na one of di best players for di competition and she show again for di semifinal, afta her player-of-di-match performance against Super Falcons of Nigeria for di quarterfinal.
For dat game against di 10-time champions Nigeria, 22-year-old Michaely Bihina bin make as many as nine saves; di most saves for single match for di competition so far.
She deny di reigning champions di chance to defend dia title.
Afta dat game, Bihina wit tears tok say “na dream come true for me to beat Nigeria. My teammates bin do ogbonge job in front of me, we bin defend togeda wey we dey focused until di final whistle”
“We dey proud of dis achievement, we finally break di curse against Nigeria,” she tok Caf media.
Cameroon bin lose three Wafcon finals against Nigeria – 5-0 for 2004, 2-0 for 2014 and 1-0 for 2016.
But now dem don finally break di jinx against di Super Falcons
Wia dis foto come from, FECAFOOT/FACEBOOK
Bihina save four penalties wit oda ogbonge saves against Morocco
For di semifinal game, Morocco bin dominate wit dia passes and possession di whole game.
In fact, di Atlas Lionesses create many chances to score for dat game wey enter extra time.
Morocco win last-minute penalty afta one Cameroon defender shove di striker for her face wey she dey bleed.
Afta VAR check, di ref bin award penalty but 27-year-old Fatima Tagnaout step up wey she miss di penalty.
Michaely Bihina carry her strong hands to save di penalty, to push di semifinal to penalty shootout.
Na dia Bihina don shine again.
Di Benfica keeper save three penalties from Kenza Chapelle, Meryem Atiq and Sakina Ouzraoui as di Indomitable lionesses win di shootout 3-1.
Dat na di first time Morocco bin lose shootout for dia last four attempts.
For Michaely Bihina, dat na her third clean sheet for five games for dis tournament, wia she concede only two goals.
She don win back-to-back player of di match awards for di tournament wia she don enta di final to face debutants Malawi wey bin sama Algeria 3-1 for di oda semifinal game.
Already sabi pipo and fans say Michaely Bihina be one of di contenders for player of dis competition togeda wit di Chawinga sisters – Tabitha Chawinga (30) and Temwa Chawinga (27).
Tabitha bin score three goals wia her junior sister Temwa now dey lead di goal chart wit five goals and two assists.
Cameroon now dey unbeaten for di tournament – for di group stage dem beat Mali 2-1, beat Ghana 1-0 bifor dem draw 1-1 wit Cape Verde.
For di quarterfinal dem sama Nigeria 1-0 wey dem now scata host kontri Morocco 3-1 for penalties.
But who be Michaely Bihina?
Wia dis foto come from, FECAFOOT/FACEBOOK
Di star goalkeeper start her career as striker
Dem born her for Ekounou, Nkoldongo for Yaoundé, wia she bin start as a striker.
But as she bin dey grow, she become tall, na so her coach advise her to switch positions.
“My coach bin tok me say I be too tall to be striker, so make I change and become goalkeeper. Na so I switch and six months later, di national team bin invite me,” Bihina tok Caf media for one interview.
At 15 years, she join Portuguese team Racing Power wia she help dem to win di league title and gain promotion to di top division.
Her current team Benfica bin sign her for 1 Febraury 2026 wia she bin win di double – di league and Portuguese cup.
Now for di same period, she don lead Cameroon to qualify for di 2027 Women’s world cup for Brazil and di final of di Wafcon.
Wia dis foto come from, FECAFOOT/FACEBOOK
Everitin don set for di 22-year-old so far, wia she dey hope to add di Wafcon title to her trophy cabinet.
For her age, Bihina already be cult heroine for her home kontri and she bin write her name for Wafcon history as di only first and only goalkeeper to save four penalties for one game.
She go face one las test against di Chawinga sisters of Malawi for di final.
“Dat game go be good game, we go try our best just like we do for di oda games. We go challenge ourserf.”
Whatever go happun for dat final on Sunday 16 August, Michaely Bihina already bin write her name for Wafcon history, to win di title go be icing on di cake to crown wetin be spectacular display by di 22-year-old.
Credit: Source link