Wia dis foto come from, MICHAEL MILLER/ALEX GRIMMVIA GETTY IMAGES
Published
Read am in 4 mins
Di Teranga Lions go jam wit di Red Devils of Belgium for dia R32 clash for di 2026 Fifa World Cup on Wednesday night.
Senegal qualify for dis round afta dem win only one game out of di three group stage games.
Dem lose 3-1 to Group I winners France, Norway sama dem 3-2 bifor dem thrash 10-man Iraq 5-0.
Wit di fresh format for qualification, Senegal be one of di eight best third-place teams wey progress wit three points and positive goal difference sake of di plenti goals dem score against Iraq.
Critics say di Teranga Lions no show for di group stage, na so dem dey expect dem to turn up for di knockout stage.
Wia dis foto come from, THOAGO SZWARC/GETTY IMAGES
For Belgium, dem finish dia group G unbeaten – one win and two draws.
Di Red Devils play 1-1 draw wit Egypt, wey dem draw 0-0 wit Iran bifor dem scata New Zealand 5-1 for dia last group game.
Small small, dem also dey show for di tournament but dem gatz overcome di 2021 Afcon champions Senegal if dem go reach di round of 16.
Di two teams go face each oda for di Seattle Stadium later on Wednesday as dem go try to keep dia momentum.
Wetin di coaches tok ahead of di game
Belgium coach Rudi Garcia tok say Senegal na di best of di third-place teams wey qualify for dis round, but im team dey physically ready to face dem.
“Evribodi dey available for dis game, na good tin sake of e neva dey so for us for di first three games,” Garcia tok.
Lukaku wey be Belgium all-time scorer score one goal wey im make impact from di bench for dia game against Egypt, im dey fit and available.
Jeremy Doku wey miss dia second game wit Iran sake of im travel to witness di birth of im pikin, now dey available.
Rudi Garcia say im wish dem win more games for di group stage bifor but e neva be too late to continue dia winning streak.
For Senegal coach Pape Thiaw, im admit say di Teranga Lions neva start di tournament well but im believe say di team go dey ready to jam wit Belgium.
“We gatz win dis game, we dey determined. Na different competition now from di group stage, di fact say you win di group no mean say oda teams no go fit scata you, like wetin Morocco bin do to Netherlands.”
Thiaw add say “we don work on our team, di mistakes we do against France and Norway, di individual errors, we don fix dem, we go dey ready for di Red Lions”.
Belgium attacker Leandro Trossard wey don shine for dia group games say im dey feel good ahead of di game.
“Pipo don happy, di atmosphere dey high for my kontri, I tink say we dey grow in dis tournament,” di Arsenal forward tok.
For Senegal midfielder Papa Gueye, time don reach for dem to show dia quality.
“We bin need to show anoda side of our team for dat Iraq game; wey we show di whole world di team we be.”
Ismaila Sarr dey lead wit three goals wey Papa Gueye wey comot di bench to score two goals against Iraq, dey in line to start di game.
Wia dis foto come from, JAMIE SQUIRES/GETTY IMAGES
Possible lineups for both teams
Courtois (GK); Castagne, Mechele, Theate, De Cuyper; Tielemans ©, Vanaken; Doku, De Bruyne, Trossard; Ketelaere
Diaw; Diatta, Seck, Niakhate, Jakobs; Diarra, Gueye ©, Camara; Mbaye, Sarr, Mane
Di game go happun at 8 PM GMT (9PM WAT) for di Seattle Stadium.
Make you join us for dat time for di live commentary.
Credit: Source link