Mali attacks: Militants target five cities, attackers kpai, AU chook mouth – Wetin dey happun for Mali?
Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Published
Read am in 4 mins
Mali army say dem kill several armed militants wey attack dia military positions for some parts of di kontri ova di weekend.
For dia statement, di army say di situation dey under control for five cities wey di militants target.
Di militants bin attack locations like Alguel-Hoc, Anéfis, and Goa for di northern part of Mali, Kenioroba for di southern part near di capital Bamako, and Sévaré for di central region.
Howeva, one fighter wey di side of di govment kpai during di attack while four odas sustain injuries for di northern side, according to wetin Malian army announce.
Tuareg separatists from di Azawad Liberation Front (FLA) say na dem dey responsible for attacks for three of di locations wia Malian troops and Russian paramilitary troops from Africa Corps dey present.
Di Malian army say dem neutralise “20 terrorists on motorcycles and equipped vehicles.”
Dis attacks dey come not more two months afta anoda coordinated attacks between JNIM jihadists and di FLA rebels rock several parts of di kontri.
During di previous attacks, di jihadists take some territories from di Malian army.
Mali currently dey under military junta led by Gen Assimi Goïta, wey seize power through coup for 2021.
Mali army react to multiple attacks
Mali army say dem don take control of di areas wey di militants target during dia attacks.
According to di statement, di General Staff of di Armed Forces say coordinated air and ground operation wey dem do on Saturday, allow dem to takeova di areas.
Di Malian Armed Forces (FAMa), say dem get support from allied forces, to “retake di initiative” and restore control for all di places wey di militants target wit dia attacks.
For plenti years now, Mali and dia oda Sahel neighbours Burkina Faso and Niger dey face jihadist insurgency.
Mali military say dem regain control of areas wey jihadist and separatist fighters target for dia coordinated attacks, but fresh fighting still dey kontinue for di northern town of Anéfis, wia di situation on di ground still dey hot.
“Fighting resume for July 5 for Anéfis, afta di arrival of enemy reinforcements in personnel and equipment. FAMa units remain engaged throughout di day, as dem kontinue to dey combat operations wit courage, discipline and determination”, di Mali army statement say.
Different wave of coordinated attacks go round for July 4 by fighters from di Al-Qaeda-linked Group for di Support of Islam and Muslims (JNIM) and dia separatist allies for di Azawad Liberation Front (FLA).
Di different assaults target military positions for northern, central and southern Mali.
Security sources and local residents also report say dem launch attack on prison for southern parts of Mali.
African Union react to Mali attacks
Di attacks for Mali don call for condemnation from African Union Commission Chairperson Mahmoud Ali Youssouf, wey describe di situation as coordinated terrorist attacks against Mali.
Di AU chief say dem stand in solidarity wit di Malian authorities and dia pipo.
E further warn say such violence threaten regional stability say dem go make efforts to combat terrorism and restore security across di Sahel.
Attention don shift go Anéfis, one of di strategic town on di route to di city wia rebel hold for northern city of Kidal.
Reports say Malian forces and Russian Africa Corps personnel dey locked in serious contest wit di FLA and JNIM alliance for control of di area.
While di military dey insist say dem remain engaged for di town, di FLA claim say dem don alreadi seize Anéfis and inflicted heavy losses on govment and Russian forces.
We neva independently verify di claims, and di status of di town still dey unclear.
Dis latest fighting dey show growing challenge wey dey face junta-led Mali as armed groups dey expand dia reach across multiple regions.
For June 2026, di Malian army (Fama) tok say dem kill several senior militants wey dey hold meeting for di central Douentza Region.
Malian army also say dem kill unspecified number of militants who bin dey prepare to attack di army unit wey dey escort convoy of fuel tankers near di capital Bamako.
Credit: Source link