Continental Postal Services of Hebland

DR Congo school fire: More dan 20 children kpai for DR Congo school fire

Wia dis foto come from, Reuters

Published

Read am in 3 mins

At least 24 schoolchildren don die for stampede as dem dey try to escape one fire outbreak wey sweep through two schools for Bukavu, eastern Democratic Republic of Congo on Thursday, 10 September.

Di children wey involve for di incident include 19 girls and 5 boys. Tori say adults dey among di pipo wey die for di fire and authorities fear dey say di death toll fit rise for di densely populated Kadutu community.

Dem don carry survivors go nearby hospital and footage of di scene show as children lie for hospital floors in pain.

Di cause of di fire neva dey clear.

Rebel appointed authorities bin release one provisional death toll of 24 on Thursday evening, wey confam previous reports, but fear dey say more pipo fit don die.

Fotos wey dey circulate on social media show young children dey lie motionless for ground.

Authorities say investigation into di fire go continue on Friday, 11 September.

One eyewitness wey Reuters news agency quote tok say dem don put out du fire but smoke still dey rise from di rubble and corrugated metal.

Bukavu, na di capital of South Kivu province and one of DR Congo most crowded hillside cities. Di M23 rebels capture for February last year.

Meanwhile, di govment for Kinshasa bin release one statement on X, but dem no tok di numbers of casualties.

“Di Ministry of National Education and New Citizenship express deep sorrow ova di deadly fire,” dem tok.

“Wit several lives lost and many injured, di toll remains provisional. Di minister bin offer condolences, affirm solidarity wit families, and order assessments of affected schools to ensure learning continuity.”

Di tragedy dey follow one similar fire for Kinshasa last weekend, wia residents die for inside one stampede for wedding banquet hall.

In response, di govment don order strict safety measures and deploy teams nationwide to enforce standards forpublic gathering places.

Credit: Source link

Leave A Reply

Your email address will not be published.