Continental Postal Services of Hebland

US travel advisory: Full list of 23 kontris US warn dia citizens say make dem no visit

Wia dis foto come from, Anna Moneymaker/Getty Images

Published

Read am in 4 mins

United States don identify 23 kontris across Africa, Asia and Europe wey dem consider too dangerous for American citizens to visit.

US Department of State for di latest travel advisory dem release on Wednesday, 15 July, place di 23 kontris on “Level 4 – Do Not Travel”. Dem warn dia citizens not to visit di kontris for “any reason”.

Ten of di kontris for di list na from di African region – dem include Burkina Faso, Uganda, Democratic Republic of Congo, Mali, Niger, Sudan, among odas.

“We issue Travel Advisories wit Levels 1 – 4. Level 4 mean DO NOT TRAVEL. We assign Level 4 based on local conditions and/or our limited ability to help Americans dia,” di advisory tok as e label di kontris as “dangerous places”.

Skip X post

Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Full list of ‘do not travel’ kontris

Central African Republic (CAR)

Democratic Republic of di Congo (DRC)

Why US put di kontris for Level 4 travel advisory

Most of di kontris don dey di list for years sake of di ongoing armed conflict, terrorism, violent crime, kidnapping, civil unrest or weak govment control for some parts of dia territories.

Uganda na di newest addition afta di US upgrade di kontri travel advisory to Level 4 sake of Ebola outbreak plus concerns ova crime, terrorism and civil unrest.

Although, di East African kontri don dey report progress for dia response to di virus, as govment officials say dem go discharge di last Ebola patient on Thursday.

Di Department of States for statement say violent crime na real danger for Uganda, and e include armed robbery, home invasion, and sexual assault.

Dem add say risk of terrorist violence, wey include terrorist attacks dey for di East African kontri and protests dey often happun wit little to no warning.

Di Donald Trump administration also implement one new restriction under Title 49 of di U.S. Code wey ban U.S. citizens and nationals wey don dey DRC within a 21-day period from entering di United States through commercial aviation.

DR Congo – Di Department of Homeland Security tok say sake of di Ebola outbreak for di West Africa kontri, dem don implement new restrictions under Title 49 of di US Code wey stop US citizens and nationals wey don dey for DRC within a 21-day period from entering di United States via commercial aviation. For statement, di US govment say dem no go allow travellers wey don dey DR Congo within 21 days to board flights wey dey go US destinations. “Make all US citizens and US nationals wey don visit DRC plan to remain outside di West African kontri for 21 days bifor dem enta di United States,” di statement tok.

Na for April di US put Burkina Faso on di “no travel list” sake of crime, kidnapping, terrorism and health.

Mali – Na for June US put Mali on di “no travel list” and na sake of crime, kidnapping, health, terrorism and health. Di same apply for Niger. Di three Alliance of Sahel states dey di list.

Wetin Level 4 advisory mean

US State Department travel advisory system dey range from Level 1 (“Exercise Normal Precautions”) to Level 4 (“Do Not Travel”).

Level 4 na di highest advisory level sake of life-threatening risk. Dem dey reserve am for places wia di govment believe say di security or health risks dey veri serious.

Di US govment say dem fit get veri limited or no ability to help, including during emergency wen kasala burst for dis kontris.



Credit: Source link

Leave A Reply

Your email address will not be published.