Di goal from Alexia Putella put Spain ahead of Nigeria Super Falcons to lead group C for di 2024 Olympics.
World Champions Spain clash wit Nigeria for di second Group C match of di 2024 Olympics football event for Paris, France.
For di 11 minutes, chance show for Nigeria Super Falcons as Asisat Oshoala dribble one Spanish player from corner.
She find space pass di ball to her team mate but di shot miss target.
Serious gbege bin happun to di Falcons for di 54th minutes wen Salma Paralluelo score from di corner wey Spain play.
Di Spanish dey celebrate dia goal wen referee bin dey review di goal wit VAR. Afta di review, referee cancel di goal sake of OFFSIDE.
Spain no relent for dia search for goal and Nigeria too dey find goal dat time.
One fantastic tin na di sweet way wey Nigeria Super Falcons goalkeeper Chiamaka Nnadozie dey block shots.
She block all di shots on goal wey Spain play for di net.
Deborah Abiodun of Nigeria carry Spain player shine again as she dribble di player fall for ground, but still goal no comot.
For 65th minutes, Asisat Oshoala make solo run towards Spain goal area, she pass di ball to Rasheedat Ajibade but Ajibade play di ball inches ova di top of di post.
Rasheedat also miss one on one afta she fall for Spain box 18.
E no tey wey dem comot Michelle Alozie and Asisat Oshoala wey Spain take di lead.
Alexia Putella score for Spain for di 87th minutes from free kick area.
Nigeria Super Falcons get plenti chances but dem no convert am to goal despite di efforts of di goalkeeper Nnadozie Chiamaka.
Spain dey lead di group wit 6 points while Nigeria dey bottom wit 0 points- Japan and Brazil dey 3 points each.
Full time Spain 1-0 Nigeria
90+ 4 Referee blow whistle match don end.
90+ 1 Chance for Nigeria Ihezuo get one-one chance but Spain goalkeeper block di ball.
90′ Four minutes added time
89′ Throw for Nigeria Nicole Payne throw am but Spain intercept di ball again.
87.Goal! Spain don score , Alexia Putella score for Spain.
85′ Substitution for Nigeria, Christy Ucheibe don comot, Uchenna Kanu don enta.
81′ Good defending from Nigeria so far but Spain no wan allow di Super Falcons breath o! back to back attack.
80′ Osinachi Ohale of Nigeria save anoda chance from Spain goal attempt.
79′ Osinachi Ohale of Nigeria put out beta defence to hold di ball for Nigeria goal area bifor Chiamaka Nnadozie save am.
78′ Corner kick for Spain, Irene Paredes head am off target.
77′ Spain make anoda goal attempt but Carmona play di ball ova to corner kick.
76′ Olga of Spain make goal attempt but e land for Chiamaka Nnadozie hand.
73′ Double substitution for Nigeria, Michelle Alozie don comot Nicole Payne don enta, Asisat Oshoala don comot Ihezuo don enta.’
72′ Good pass to Asisat but she dey offside position .
71′ 68′ Throw-in for Nigeria, Michelle Alozie throw di ball e land for Toni Payne leg but Spain defenders gada her, she later pass di ball to Ajibade but referee blow foul.
65′ Chance for Nigeria, Asisat Oshoala make solo run towards Spain goal area, she pass di ball to Rasheedat Ajibade but Ajibade play di ball inches ova di top of di post.
63′ Spain no wan allow Nigeria hold ball at all but Nigeria defence no dey give dem.
61′ Substitution for Nigeria Esther Okoronkwo don play finish Ifeoma Onumonu enta.
59′ Substitution for Spain Teresa Abelleira don comot Patri Guijarro don enta
54′ NO GOAL! afta di VAR review Salma Paralluelo of Spain dey OFFSIDE !
53‘ Goal! Spain score from cornerkick as Salma Paralluelo get ball from di corner kick and head am inside net.
52′ Deborah Abiodun of Nigeria carry Spain player shine again as she dribble di player fall for ground.
51′ Nigeria get one beta ball from di side flank but Spain defender clear di ball.
50′ Spain get corner kick again, Olga Carmona play am but notin come out.
48′ Spain don start to disturn again now now o! Alexia Putellas attempt go land straight for Chiamaka Nnadozie hand.
46′ Double substitution for Spain Lucia Garcia don comot Athenea del Castillo don enta. Oihane Hernández don play finish Olga Carmona don replace her.
46′ Referee blow whistle second don start
First Half
45′ One minute added time.
45′ Save! Brillant save from Chiamaka Nnadozie, she block di goal bound corner kick from Spain ogbonge player Alexia Putellas..
44′ Good defending from Michelle Alozie of Nigeria, corner kick for Spain, dem play m but e go corner again.
41′ Nigeria Deborah Abiodun don collect di ball she pass am but Spainnintercept am again.
40′ Spain no wan give Nigeria breathing space o, dem dey hold ball like say…
37′ Yellow card for Asisat Oshoala
35′ Chance for Nigeria! Throw-in for Nigeria Okeke throw di ball to Oshoala, Oshoala pass di ball to Rasheedat Ajibade wey make a solo run but miss di chance afta Spain goalkeeper bring her down..
33′ Michelle Alozie of Nigeria play cornerkick for Nigeria but she play am go front.
32′ Spain player dey down, she fall sake of push from cornerkick, referee bin tink say na foul against Nigeria but no be foul, game don kontinu.
29′ Deep cross from Spain player Lucia Garcia but di ball land for Nigeria defender head and e go out of play.
27′ Anoda goal attempt from Spain but Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie catch di ball.
26′ Chance for Spain, Alexia Putellas get chance to put di ball inside Nigeria net but she no fit sake of plenti defenders. Chiamaka catch di ball.
23′ Nigeria get clear chance to score afta Okoronkwo make one beat run but nobodi dey close to assist her, di ball run pass goal post.
20′ Spain dey dominate di game, anoda freekick for dem. Teresa Abelleria play am but e go few inches ova di bar.
17′ Deborah Abiodun of Nigeria use Spain as she disturb about three Spanish player, she defend di ball well-well, she no give dem space until dem bring her down.
15′ Spain dey play short short passes but Nigeria player Okeke intercept di ball to give Nigeria possession.
13′ Spain dey dominate ball possession so far, dem dey disturb Nigeria goal area but Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie dey catch all di ball Spain dey attempt to score.
11′ Chance for Nigeria Super Falcons as Asisat Oshoala dribble ons Sapnaish player from corner flank, she find space pass di ball to her team mate but di shot miss target.
10′ Corner kick for Spain, Irene Predes play am but e land for back of di goal post
8′ Freekick for Spain Teresa Allbeleira play am but Nigeria defence clear di ball.
7′ Spain get corner kick but notin come out.
1′ Referee don blow whistle match don start.
World Champions Spain go clash wit Nigeria for di second Group C match of di 2024 Olympics football event for Paris, France.
Dis na anoda match wey Nigerians and Africans all ova di world dey look forward to, weda somtin positive fit come out for di 11-time African champions.
Di two teams get ogbonge stars and history for different football competitions but na Spain get edge pass.
Fifa women’s World Cup Silver Ball winner Jennifer Hermoso, wey also win gold for di Fifa Women’s World Cup last year dey di team.
Jennifer Hermoso wey dey 34 years na five-time top scorer for di Spanish league top division.
Rasheedat Ajibade na Nigeria star player too, she be di top scorer for di 2022 edition of di Africa Cup of Nations.
Rasheedat wey dey 24 years dey captain Nigeria for di Olympic Games football event.
She sabi position and also get speed.
Spain beat Japan 2-1 for dia opening match while Nigeria lose 1-0 to Brazil.
Dat na di second time wey Brazil women go defeat di Super Falcons for Olympic Games. For 2008, dem also beat Nigeria 3-1.
Nigeria go need pick demsef up and go again for Sunday match wen dem go face off against current Women World Cup holders, Spain.
Brazil on di oda hand go try to qualify for di next round as dem go play Japan for dia second group game on di same day.
Line Ups
Spain starting 11: Cata Coll, Oihane Hernández, Laia Aleixandri, Irene Paredes, Ona Batlle, Alexia Putellas, Teresa Abelleira, Aitana Bonmatí, Mariona Caldentey, Salma Paralluelo, Lucía García
Nigeria starting 11: Nnadozie, Okeke, Demehin, Ohale, Alozie, Abiodun, Ucheibe, Oshoala, Payne, Ajibade, Okoronkwo
Head to Head
Nigeria and Spain dey meet for di first time for International football.
Spain dey enta dis match wit evritime. Dem already get 3 points and dem be World champions.
While Nigeria get plenti work to do- to beat di Spain or dem lose, di Super Falcons no go give dem beta chance to qualify for di next round.
Even though Nigeria still get past glory of African champions, dem no dey too do well for international competitions.
We go dey update dis tori…
Credit: Source link