Nigeria go play Ghana for international friendly match dis week.
Dis na di first time wey di two kontris go play afta di African Cup of Nations wey Ivory Coast host and win.
Super Eagles lose di final to di host Ivory Coast, while di Black Stars comot for di group stage.
Na afta di Black Stars comot wey dem sack dia manager Chris Hughton and replace am wit Otto Addo on interim basis.
Finidi George go oversee matters for Nigeria afta Jose Peseiro resign.
Dis na eviritin you need to know about di international friendly game.
Wen be Nigeria vs Ghana friendly match?
Kick off time for Nigeria vs Ghana na 4:00pm West African time on Friday March 22, 2024.
Di venue of di match na di Grand de Stade Marrakech, for Morocco.
Nigeria vs Ghana team news
Nigeria get some injury problems, di likes of Victor Osimhen, Taiwo Awoniyi, Tyronne Ebuehi and Gabriel Osho go miss dis game.
Ghana also dey without one key player, Arsenal midfielder Thomas Partey.
Partey no dey available as im dey try to build up im fitness wit di Gunners.
Goalkeepers: Stanley Nwabali, Francis Uzoho, Ojo Olorunleke
Defenders: Chidozie Awaziem, Bright Osayi-Samuel, Bruno Onyemaechi, Kenneth Omeruo, Oluwasemilogo Ajayi, Calvin Bassey, Jamilu Collins, Benjamin Tianimu
Midfielders: Wilfred Ndidi, Raphael Onyedika, Alhassan Yusuf, Frank Onyeka, Alex Iwobi
Forwards: Nathan Tella, Kelechi Iheanacho, Sadiq Umar, Moses Simon, Ademola Lookman, Fisayo Dele-Bashiru, Cyriel Dessers
Goalkeepers:Lawrence Ati-Zigi, Joseph Wollacott, Frederick Asare, David Akologo
Defenders: Alidi Seidu, Tariq Lamptey, Gideon Mensah, Patrick Kpozo, Denis Odoi, Daniel Amartey, Alexander Djiku, Nathaniel Adiei, Mohammed Salisu,
Midfielders: Elisha Owusu, Mohammed Diomande, Samed Abdul Salis, Andre Ayew, Mohammed Kudus, Baba Iddrisu, Edmund Addo,
Wingers: Ernest Nuamah, Osman Bukari, Fatawu Issahaku, Ibrahim Osman
Forwards: Jordan Ayew, Antoine Semenyo
Finidi George profile
Former Nigeria forward Finidi George go dey Super Eagles dugout wen dem face dia arch-rivals Ghana.
Finidi wey be 52-years na former Ajax Amsterdam and Real Betis player.
Im bin play im first match for Nigeria wia e score, for dia Africa Cup of Nations qualifying game against Burkina Faso for National Stadium, Lagos on 27 July 1991.
Na key player for Nigeria 1994 World Cup squad wey include di likes of Rashidi Yekini.
George wey come from Rivers State, also play for Calabar Rovers and Sharks FC for local league bifor im move go Europe.
Afta Jose Peseiro resign, Nigeria football federation announce say im go take charge for di friendly games against Ghana and Mali.
Nigeria vs Ghana head to head record
Di last time wey dis two sides jam each for competitive match na for di 2022 World Cup qualifiers for Qatar.
Ghana win di tie 1-1 on di away goals rule to qualify
Dem play 1-1 draw for Abuja for di Moshood Abiola stadium
Ghana get upper hand for dia head to head record against Nigeria.
Di Black Stars get 22 wins while Super Eagles get 11 wins and 20 draws.
See oda match result between Ghana and Nigeria
2011/10/11: Ghana 0-0 Nigeria – International Friendly
2010/01/28: Ghana 1-0 Nigeria – Caf Africa Cup of Nations
2008/02/03: Ghana 2-1 Nigeria – Caf Africa Cup of Nations
2007/02/06: Ghana 4-1 Nigeria – International Club Friendly
2006/01/23: Nigeria 1-0 Ghana – Caf Africa Cup of Nations
Credit: Source link